SOMEBODY

Lit Vybz

0 fans

Lit Vybz


2:51

 The easy, fast & fun way to learn how to sing: 30DaySinger.com

Omo shey you dey talk for my front
Say you like my style
You come go for my back you dey try kill my vibe
You dey lie for your friends say I be your guy
But deep down, you be somebody wey no dey try for me
For me
You no dey try for me
Omo you no dey try for me

Somebody
Na my guy Yes, but e no dey rate me
Na wetin e tell person
Na make the person dey hate me
I no be chocolate but somebody wan taste me
While somebody don swear say she no fit ever date me
Somebody dey, just dey pray make I die quick

I dey press and you no wan make the boy pick

Somebody talk say last last I no go make am
Say this music I dey do, omo na fake me I dey fake am
Somebody wan owe, with no plans to take pay me
E wan make I mad make psycha people chain
Anything I do, omo somebody dey vex and if na
Somebody dey give, somebody no wan make I get

Somebody dey crush
She dey hope say I crush back
But somebody wey I love, just dey play with my small heart
Somebody no send me, nothing of me even matter
Somebody na my blood but when I need help e turn water

Omo shey you dey talk for my front
Say you like my style
You come go for my back
You dey try kill my vibe
You dey lie for your friends say I be your guy
But deep down you be somebody wey no dey try for me

For me
You no no dey try for me
Omo you no dey try for me

Somebody dey vex, anytime when I come through
Somebody dey reason me
Say me self I too do
Somebody don carry my pictures self enter voodoo
E wan make I dey miss opportunities like Yakubu

Somebody self, no dey like to dey near me
All because of wetin person don tell am about
Somebody no want make I see money chop
Somebody say my career no go pass lekki lagos

As e be now somebody no dey reason my matter
To even download my song, be like waste of him data
Somebody wish say, me and himself met earlier
Somebody don dey plan how to take chop for my burial

Somebody wan help, but everything for am dey hard
Or because somebody don tell am say me am too bad
Somebody no send, for am anything goes
But somebody wey really care
Na only God knows

Omo shey you dey talk for my front
Say you like my style
You come go for my back
You dey try kill my vibe
You dey lie for your friends say I be your guy
But deep down you be somebody wey no dey try for me
For me
You no no dey try for me
Omo you no dey try for me

Tigerman on the mix

 The easy, fast & fun way to learn how to sing: 30DaySinger.com

Written by: Prince Thompson, Dominic Kwen

Lyrics © O/B/O DistroKid

Lyrics Licensed & Provided by LyricFind

Discuss the SOMEBODY Lyrics with the community:

0 Comments

    Citation

    Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:

    Style:MLAChicagoAPA

    "SOMEBODY Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 23 Sep. 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/14156234/Lit+Vybz/SOMEBODY>.

    Missing lyrics by Lit Vybz?

    Know any other songs by Lit Vybz? Don't keep it to yourself!

    Browse Lyrics.com

    Quiz

    Are you a music master?

    »
    Which Beethoven symphony number is in F major?
    A 1
    B 8
    C 3
    D 5

    Free, no signup required:

    Add to Chrome

    Get instant explanation for any lyrics that hits you anywhere on the web!

    Free, no signup required:

    Add to Firefox

    Get instant explanation for any acronym or abbreviation that hits you anywhere on the web!

    Lit Vybz tracks

    On Radio Right Now

    Loading...

    Powered by OnRad.io